Three-year-old girl dey among dozen wey die for Mozambique sake of ‘intense’ cyclone

Three-year-old girl dey among dozen wey die for Mozambique sake of 'intense' cyclone
Three-year-old girl dey among dozen wey die for Mozambique sake of 'intense' cyclone

At least 34 pipo don die sake of “one of di most intense storms wey dem don eva record” for northern Mozambique.

Dis na wetin di National Institute of Risk and Disaster Management (INGD) for di kontri tok.

Cyclone Chido bin make landfall for Mozambique on Sunday, afta e cause disaster for di Indian Ocean territory of Mayotte.

E be like say hundreds don die for Mayotte – one French overseas region – and plenti oda pipo – including more dan 200 Red Cross volunteers – dey miss.

Di INGD don call di situation for Mozambique “heart-breaking” as dem bin warn say di death toll fit still rise.

More dan 34,000 Mozambican families don lose dia homes to Chido, wey carry heavy winds of around 260km/h (160mph).

E destroy schools, health facilities and fishing boats.

Chido bin strike di northern provinces wey cyclones dey regularly scata.

Dem dey also suffer attacks from Islamist militants.

Di cyclone bin make landfall for Cabo Delgado bifor e travel go inside land to Niassa and Nampula, wia one three-year-old girl dey among di pipo wey die.

Most of di pipo wey Chido kill, na pipo wey objects wey dey fall down, like brick walls hit, na wetin INGD spokesperson Paulo Tomas tok.

Electricity and communications dey affected too, state-owned power company Electricidade de Moçambique (EDM) announce say around 200,000 customers no get electricity.

For Mayotte, widespread damage to infrastructure – wit power lines wey don come down and impassable roads – na one of di tins wey dey block emergency operations.

Chido na di strongest storm to strike di territory for more dan 90 years.

Di official death toll on di islands don reach 21, but dem believe say hundreds of pipo fit don die.

“We dey tok about di entire area, if not di whole island wey dey completely destroyed and washed away.

“Wetin dey really scary na di number of pipo wey still dey miss,” Tommaso Della Longa, one spokesperson for di International Federation of Red Cross, tell di BBC.

Im add say more dan 200 Red Cross volunteers dey among di pipo wey dem dey fear say dey miss.

One French MP for di island, Estelle Youssouffa, tok say she dey fear say tens of thousands of pipo don die sake of di cyclone.

She tell di BBC say di magnitude of di destruction bin dey hard to understand as 90% of di buildings for di area damage.

Di French authorities don impose night-time curfew for Mayotte to prevent looting.

Just last year, Mozambique bin suffer from Cyclone Freddy, one of di longest-lived storms wey dem don eva record for di whole Southern Hemisphere, if not for di whole world.

More dan 180 pipo for di kontri bin die, na wetin di World Meteorological Organization tok.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *