
Di electoral commission for Ghana say dem dey reject nine constituency results for di 7 December election wey just end.
Oga of di commission say five of di parliamentary results wia dem declare na “illegal”, wia four odas dey incomplete.
For one press conference, Jean Mensa say “di results wey our officials declare for places like Okaikwei central, Ablekuma north, Tema central, Dome-kwabenya get wahala sake of political party pipo don threaten our staff wia dem declare dis results.”
“For some places, our returning officers bin face threat at gun-point wia dem declare di results wia no dey reflect for di collation documents,” di electoral commission boss tok.
For some oda constituencies, “political party supporters bin attack our officers, burn ballot boxes and sometimes destroy our computers wia don dey collate di results.”
For di Okaikwei constituency, di EC officer bin declare di winner without results of 31 polling stations wia di Ablekuma north winner bin dey declared without results of 62 polling stations, according to di electoral commission boss.
“For Tema central, di electoral officer bin declare di winner afta di party supporters and executives don threaten am well well, so im use 146 out of 148 polling station results to declare di winner.”
Oga Jean Mensa tok say “sake of dis kind violence and burning of our offices for some regions, di commission no fit recognise di declaration of di results for Ahafo Ano southwest, Ahafo Ano north and Nsawam adoagyiri, odawise e go create bad precedent for future elections.”