‘Keep your hands for di front of your chest like boxer’ and oda ways to survive stampede

'Keep your hands for di front of your chest like boxer' and oda ways to survive stampede
'Keep your hands for di front of your chest like boxer' and oda ways to survive stampede

At least 50 pipo don die around Nigeria in di last week on top stampede mata wey happun for three separate parts of di kontri.

On Wednesday, 35 pikin dem die for stampede for one funfair wey bin dey happun for Ibadan, Oyo state capital for di south west of Nigeria.

On Saturday, authorities for Abuja confam say at least ten pipo wey include four pikin bin die for stampede for catholic church wen dem dey distribute food items to poor pipo.

For di southeast of di kontri, on di same Saturday, anoda stampede also claim lives.

Dis one happun for Okija, Anambra State. E happun as one charity bin dey share rice and oda foodstuffs.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *