
Tragedy strike for Ibadan, di Oyo State capital on Wednesday 18 December wen crush appun for di Children Funfair wey di former Queen of Ile Ife Olori Naomi Ogunwusi bin organise.
Mr Musiliu no go forget dat day in a hurry as im 10-year-old daughter Shofiyat Musiliu dey part of di 35 children wey die for di stampede.
According to Mr Musiliu wey follow BBC Pidgin tok, im wife bin carry four children go di event.
“My wife bin leave for di event around 5:00am and at approximately 7:30am she call me to inform me say Shofiyat don faint and say dem don rush am to di hospital. Afta I hear dis, I hurry to di event venue becos she bin go dia wit four children.
Mr Musiliu say dem receive call from di hospital say dia daughter don die. E say dem bury Shofiyat on Thursday.
Mariam Salawu get di same experience wit di Mr Wale as she also take four children go di event and only return wit three as she lost one identified as six-year-old Ayomide.