
Tributes don dey pour in for victims of di Ibadan children funfair tragedy wey claim di lives of 35 children and leave several odas injured.
On Wednesday 18 December, tragedy bin knock for Ibadan, Oyo state southwest Nigeria wen one event wey suppose be celebration party for children turn deadly sake of stampede.
Nigeria President Bola Tinubu don pay condolence to di family of those wey lost dia loved ones.
For statement, Oga Tinubu say make relevant authorities investigate wetin cause di incident. E also say e dey important to know weda na negligence or deliberate actions contribute to wetin happun, and make dem ensure say di investigation dey transparent.
“Our children safety and well-being remain paramount. No event suppose compromise dia safety or take precedence ova dia lives.”