Five tins President Bola Tinubu tok for im first media chat

Five tins President Bola Tinubu tok for im first media chat
Five tins President Bola Tinubu tok for im first media chat

Nigeria President Bola Tinubu don do im first media chat with journalists.

For di chat, di president tell Nigerians say 2025, na promising year as e thank Nigerians again for electing am to serve.

Di president wey say e no go take Nigeria confidence in am take joke also ask for cooperation and understanding.

E add say e understand di challenges, economic problems wey dey ground, but assure say promise dey and Nigeria dey on di right path and tomorrow go bring a glorious day.

Dis na di top points from di president chat with tori pipo

On di recent stampede and food security

Di president no hold back to chook mouth on di recent stampede tragedy wey take di lives of pipo including children wey go event to collect food and oda palliatives.

E condole with di family of those wey lose loved ones as e say di organisers make mistakes.

“E dey very sad say pipo no dey well organised. We just need to dey more disciplined for our society. Condolences to those wey lose family members.

I don dey give out food, clothing and envelopes for Bourdillon for di last 10 to five years, I never experience dis kain incident becos we dey organised and disciplined. If you know you no get enough to give, no even attempt am or publicise am na im be di question.” Di president tok.

“Every society get hungry pipo, America, Britain get food banks but dem dey organised, dem dey take token to dey for line and dey collect turn-by turn.

E dey unfortunate, e dey show for our bus tops wia pipo no wan even dey queue before dem rush enter vehicle.

E dey very sad but we go continue to learn from our mistakes. For me I see am as big error on di part of di organisers.” E add.

On food security to address di hunger wey dey di land, di president hail di new Ministry of livestock development wey get mandate to solve di problem.

“Ministry of livestock development bin never dey before, I dey travel round di world to campaign and sell Nigeria. Di ministry na to turn a disaster to prosperity, we get arable land, we get animal stock na just to remove di conflicting element and commercialise di venture.

I go Brazil, see wetin dey happun dia, within two days, I get a pledge of 2.5brillon dollars, and dem don come Nigeria to turn wetin we see as tragedy to opportunity and prosperity.

We fit feed ourselves, export and feed oda nations. Our pipo, some of di ministers dey Saudi Arabia right now dey discuss di opportunity for food growth and supply.” Tinubu tok.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *